P-Square
Why E Be Say
[Intro]
Ai
Ooh yeah eh
Ooh yeah eh
Yeah ah eh, no-o
Chai
I don die eh
I don die eh
Ooh yeah (yeah ah)
Why e be say, the wrong thing be say but the right thing be say
Ai


[Verse 1]
(Why e be say)
The way that we are living are not supposed to be the way you and I are still living
(Why e be say)
The leaders just dey chop money dey go because they think say we all no dey see them
(Why e be say)
They took away our rights and make silly promises, they want us to believe them
Why e be say some people too dey lie
Why e be say some people no dey try ai
Corruption na frustration na dey bring back condition is what we are feeling
(Why e be say)
Some people just sit down, dey just dey look
Day and night they staring at the ceiling
(Why e be say)
They look into our eyes and tell us say e go better while the baggers still stealing
Why e be say some people too dey lie
Why e be say some people no dey try
I don die eh
[Chorus]
Why e be say anytime we wan do wetin we go do or say wetin wey we go say (na big lie eh)
The wrong thing be say them no want make we dey do wetin we go do or say wetin wey we go say
The right thing be say we supposed to do
Wetin we go do or say wetin wey we go say
Why e be say, the wrong thing be say but the right thing be say eh ah eh

[Verse 2]
(The wrong thing be say)
We dey dey fight, dey try to kill each other
When we supposed to love one another
(The wrong thing be say)
Because them no dey go worship together
Every brother try to kill their fellow brother
(The wrong thing be say)
Even as we still dey dey suffer
We still dey try to dey rob one another
Why, my brother, why you dey chook eye for your brother
The leaders dey dey chop the bread and butter
In our society, we no dey try make live like one family
What a tragedy, with our wealth we still dey live in poverty
(The wrong thing be say)
As poor man dey holla (chineke), the rich ones dey hammer (yes o)
The wrong thing be say things dey scatter
The wrong thing be say we no dey bother
I don die eh
[Chorus]
Why e be say anytime we wan do wetin we go do or say wetin wey we go say (na big lie eh)
The wrong thing be say them no want make we dey do wetin we go do or say wetin wey we go say
The right thing be say we supposed to do
Wetin we go do or say wetin wey we go say
Why e be say, the wrong thing be say but the right thing be say eh ah eh
Why e be say now, why e be say
See the wrong thing be say
But the right thing, the right thing, the right thing, the right thing be say


[Verse 3]
All man supposed to get money, all man supposed to dey jolly
(The right thing be say)
All man supposed to get motor, all man supposed to dey kolo
(The right thing be say)
We supposed to get energy and power, supposed to get better rod and mortar eh
But why e be say some people no dey try
Why e be say some people too dey lie
I don die eh

[Chorus]
Why e be say anytime we wan do wetin we go do or say wetin wey we go say (na big lie eh)
The wrong thing be say them no want make we dey do wetin we go do or say wetin wey we go say
The right thing be say we supposed to do
Wetin we go do or say wetin wey we go say
Why e be say, the wrong thing be say but the right thing be say eh ah
Why e be say now, why e be say anytime we wan do wetin we go do or say wetin wey we go say (the wrong thing be say)
The wrong thing be say them no want make we dey do wetin we go do or say wetin wey we go say
The right thing be say we supposed to do
Wetin we go do or say wetin wey we go say
Why e be say, the wrong thing be say but the right thing be say eh ah eh ah

[Outro]
Why e be say
Why e be say
Oh oh